Di non academic staff dey para on top di sharing formula of di 40 billion earned allowance moni wey goment promise to pay dem and ASUU togeda. While ASUU dey collect 75 percent of di moni, dia share na 25 percent. Di Joint Action Committee (JAC) of di two unions explain give say di protest na against di sharing formula of N40 billion earned allowances wey goment recently approve and non-implementation of di agreement wey dem also reach wit goment for 2009. Dis protest ontop goment failure to honour one agreement wit di unions dey come just barely three weeks afta ASUU, di umbrella union of Nigerian university lecturers, suspend nine-month strike ontop di same agreement for December 2020. Di protest dey happun a day afta Nigeria Minister of Education, Adamu Adamu say di goment dey see how to review alias pospone di 18 January , 2021 resumption date. Di protest go last for three days from today to Thursday 14 Janyary 2021 and e go happun for each branch. Dis one mean say dem fit no enta street go demonstrate. Di minister say goment decision na sake of di COVID-19 case wey di rise nyafu-nyafu for di kontri. Di problem here be say all di hope wey university student get say dem go las las go back to school afta di nine months strike by ASUU don dabaru sake of dis new development dem.